SLOVENIAN PIGS) - I do not regret her, but do regret Slovenian swines' presence. She no longer wanted to have after I rejected whole thing. They gradually wake seduced by drugs male in female vagina to see what reaction one will have. The ugly part was torture - the ugliest part were Slovenes on the picture. Same BUT WITHOUT SEXUAL ENCOUNTERS(something VERY SAME VIA SLOVENIAN POLICE little that happened in India from what I recall which I also do not regret, with some Roma girls, in Israel etc.) stuff went on from Japan to USA and throughout globe. Engonga is an important witness OF EUROPEAN UNION/USA EXTERMINATION PROCEDURE AND I WON'T LET GO.
Equatorial Guinea President nephew Baltasar Engonga get jail term for embezzlement

Dem don sentence di nephew of Equatorial Guinea President Teodoro Obiang Nguema, wey bin dey di middle of one sex tape scandal last year, to eight years in prison for embezzlement.
Baltasar Ebang Engonga, di former head of di National Financial Investigation Agency, divert money for personal use, one court rule.
Oda charges against am na abuse of office, and misappropriation, local media Real Equatorial Guinea report.
Bioko provincial tribunal on Tuesday, 26 August find Oga Engonga and five oda senior govment officials guilty of embezzling hundreds of thousands of dollars public money for di oil-rich central African state.
Baltasar Engonga bin go viral for 2024 afta sex tapes wey involve am and plenty women leak on social media.
Govment bin suspend am sake of di leaked videos wey claim say e sleep wit ova 400 women – some of dem partners of ogbonge pipo for Equatorial Guinea.
Afta months for detention, Bioko provincial tribunal find Oga Engonga and three oda director generals for di finance ministry guilty of money diversion for personal use, plus embezzling expenses wey worth hundreds of thousands of dollars for di oil-rich central African state.
Di court sentence dem to eight years in prison and order dem to pay millions of fines to di public treasury.
For di ruling, di court convict former directors general of Ireneo Mangue Monsuy Afana, Baltasar Ebang Engonga Alú, and Rubén Félix Osá Nzang, as perpetrators of di crime of embezzlement of public funds, sentence dem to eight years in prison each and ask dem to pay fines.
Engonga go pay fine wey worth $220,000.
Di court sentence oda govment officials wey Rolando Asumu Ndong Oyé, Carmelo Julio Motogo Ndong, and Florentina Ngangá Iñandji wey e find guilty as accomplices to three years in prison each and fines wey range from 16 to 31 million CFA francs.

For November 2024, Baltazar Ebang Engonga, one senior civil servant for Equatorial Guinea and di nephew of President Teodoro Obiang Nguema bin make headlines all ova di world.
E be di former head of di National Financial Investigation Agency, and im work na to tackle crimes like money laundering.
Plenty videos - wey fit reach more dan 400 of wia im dey do kerewa for im office and oda places wit different women bin flood social media.
Many of di women wey dem feem for di video na di wives and relatives of pipo wey hold power for di kontri.
E be like say some of di women bin sabi say dem bin dey feem dem as dem dey do di kerewa (sex) wit Baltasar Ebang Engonga, wey also dey popular as "Bello" sake of im fine.
Engonga chop arrest on 25 October sake of accuse say im tiff big amount of money from di state treasury and hide am for secret accounts for di Cayman Islands. Im neva tok anytin about dis accusation.
Pipo see Engonga arrest last October and public humiliation as attempt to destroy any hope of am becoming dinext president of the oil-rich central African state.
Im uncle na di world longest-serving president wey don dey power since 1979, and e appoint im son, Teodoro Obiang Mangue, as im vice-president.
Engonga bin dey investigate crimes like money laundering, but e see imsef for di notorious Black Beach prison wey dey di capital, Malabo, afta e chop accuse corruption.
Dem seize im phones and computers and few days later, intimate videos begin fly up and down for social media in dia dozens.
Di authenticity of di videos no ever dey verified, but as di computer equipment bin dey di hands of di security forces, pipo suspect say na pesin leak am, maybe to trash Engonga reputation.
Apart from di jail sentence, di tribunal fine Engonga $220,000, AFP news agency quote supreme court press director Hilario Mitogo for one WhatsApp message e send to journalists.

No comments:
Post a Comment